JOKE OF THE WEEK
E get one particular restaurant wey I dey
chop 4 G.R.A. E get one oyinbo wey dey
always come chop there too…
Anytime dis oyinbo chop finish, he go
shout ”Hey”, so I wonder wetin dey make
am shout.
I decided to chop wetin d oyinbo dey
always chop so maybe me sef go shout
too. When I reach d restaurant yesterday
evening, I order wetin d man dey chop.
Dem tell me say na chicken & red wine, so
i chop am, but i no shout, I collect extra
plate, but i no still shout. I say dis oyinbo
na mumu o, why e dey always shout like
dat now?
Na then i just vex ask 4 my bill. The waiter
tell me say one plate of chicken & red wine
na N75,000 then d extra plate too na
another N75,000. Na then I shout hey!
heyy!! heyyy!!! ……!!!! heyyyyyyyyyyyyy
yyyyyyyyyyyyyyy yyyyyyyyyyyyyyy
yyyyyyyyyyyyyy yyyyyyyyyyyy… ……..
I still dey shout till now. Happy Sunday
you all.
Created at 2014-06-29 23:29:27
Back to posts
UNDER MAINTENANCE